Ba Wasa Lyrics – Mooseylion

Ba Wasa Lyrics by Mooseylion

Ba wasa
Kósaíyè ere
Where I’m from,people no Dey play
They always frown,they hardly smile their face

Cause the hardships that they facing no be play
Ba wasa
Kósaíyè ere
See Where I’m from,people no Dey play

They always frown,they hardly smile their face
Cause the hardships that they facing no be play
Now can you blame them
Can you blame them

Rice na 30k!
Garri na 50 bucks!
For a single cup!
You con say make them

Make them open teeth
E no fit be
Everyday na brand new bill
You don Dey reason plenty things

Plenty things
Ontop of plenty things
How you wan go work’
Pikin never chop’

Rent is almost due’
School fees on the way’
Your wife don get belle’
Still con Dey owe person’

How you take Dey smile’
Problem nor Dey finish!
You don Dey inside bus’
Conductor don Dey shout’

Passenger for side’
Done Dey smell again’
You don late for work’
Still con pass your bus top’

Before salary come’
Money don finish!
Aii
How can we be normal

All of us don sangba
No survey to check
Our mental state of fing minds
If Dey check am, Dem go see say many people get PTSD wey no fit make dem reason normally

Is a crazy world!
Is a crazy land!
That we living in
If oyinbo stay,Naija trenches for one day

E go think say world wan end
When he use hin eye see
Say
Light no Dey!

Say
Road no good!
Say
People Dey used!

To this kind things
And still survive can only be God’s grace
Naija my country
Ain’t no play

Ba wasa
Kósaíyè ere
Where I’m from,people no Dey play
They always frown,they hardly smile their face

Cause the hardships that they facing no be play
Ba wasa
Kósaíyè ere
See Where I’m from,people no Dey play

They always frown,they hardly smile their face
Cause the hardships that they facing no be play
Now can you blame them
Find more lyrics at westlyrics.com

Listen to their music here
WestLyrics.com Amazon Music    WestLyrics.com Apple Music
Disclosure: As an Amazon Associate and an Apple Partner, we earn from qualifying purchases

Mooseylion Lyrics – Ba Wasa

Mooseylion

Ba Wasa