Situation Lyrics – Ruggedman

Situation Lyrics by Ruggedman

Nawa oo
When you go tire to dey fight us
Park innocent people for cell like Titus
For your eyes i no holy but you self no righteous

They say police na your friend but e be like them dey whine us (cuz na only for the write ups)
When them see you for street them go change am for you
If you no no when e bad I sorry for you
Them say bail is free which bail is free to comot from there you must pay the fee

Ah ah.. na which kind life be this
Oga police wetin be this eh
I be your fellow Nigerian oo we no Dey beef o eh
Oga police wetin be this

We be your fellow Nigerians oo we no Dey beef o eh
…Instruments…
When una go tire to Dey whine us
National treasuries Dey read for minus

International depths e just dey pileup
To collect pension elders still dey lineup
Some of them even kpai up
If you come to protest them go change am for you

Na who tell the soldiers say make them shoot
Now them dey change the gist who changed gist them say nobody die for street ah ah Na which kind life be this
Oga politician Wetin be this
I be your fellow Nigerian oo we no dey beef oh eh

Oga politician Wetin be this eh
We be your fellow Nigerians oo we no dey beef oh eh
So politicians, police all of una do the right thing so we don’t have to fight
(When you come to protest them go change am for you) people have the right to protest

(Na who tell the soldiers say make they shoot) we still dey wait to know oo
Now them dey change the gist who changed gist, them say nobody die for street ah ah na which kind life be this
(Soro soke) When you come to protest them go change am for you
Na who tell the soldiers say make them shoot

Now them dey change the gist who changed gist them say nobody die for street ah ah na which kind life be thiiis
Find more lyrics at westlyrics.com

Listen to their music here
WestLyrics.com Amazon Music    WestLyrics.com Apple Music
Disclosure: As an Amazon Associate and an Apple Partner, we earn from qualifying purchases

Ruggedman Lyrics – Situation

Ruggedman

Situation